Country Hard
Intro
OH oh oh oh oh oh
Hhhhm hhhhhm hhhhhm hhhhhm hhhhhm
Mr dj music no dey lie
Make we just dey jam
As we dey try survive

Chorus
Country hard oo but
We go overcome (hardoo)
Forget your sorrow but
We go overcome, ,( iyeyiye iyeyiye)
Ojoro Don dey
Ojoro Don dey but
We go overcome 2x ,( iyeyiye iyeyiye)

Verse
Republic of suffering and smiling,( yeah) number one capital for poverty, (yeah) got her independence 1960, (ehen) most curupt and bad leadership, (yeah) poverty dey celebrate terrorism, (yeah) professor dey work for illiterate,( yeah) unemployment on the replay most oga at the top no get certificate, Chinese doctors Don escape our health minister no know where them dey, GOD bless our health workers (ehen) wey dey represent on the Frontline, (ehen) Nigerians are suffering and smiling, (no be lie) it's time for Nigerians to wake up,(wake up) Biafra say them wan break up.

Chorus
Country hard oo but
We go overcome (hardoo)
Forget your sorrow yeah
We go overcome,( iyeyiye iyeyiye)
Ojoro Don dey
Ojoro Don dey but
We go overcome 2x ,( iyeyiye iyeyiye) 2x

Verse
(Pre Ram Pam Pam Pam Pam) our people self dey funny oo, dem go dey complain plenty oo, but when e reach them turn oo, them self go do so cunny oo, okan okan ko Kan mioo,yeh, okan okan ko Kan mio,yeah, her money Don grow wing, e Don dey fly like labalabalabalaba,

Dollar na four hundred naira, (ehen) when will dollar equal naira, (next level) why we dey borrow from China (ehen) , just to service our budget,(uhum) lack of proper direction, (tell them) we need economic revolution, (ehen) if the poor man no go fit sleep I swear the rich no go fit sleeep, leaders wey dey shake coconut tree, (oya) na their own head wey them wan break ,( guy) them say you be lazy youth, election time them go use you,

Chorus
Country hard oo but
We go overcome (hardoo)
Forget your sorrow yeah
We go overcome,( iyeyiye iyeyiye)
Ojoro Don dey
Ojoro Don dey but
We go overcome 2x ,( iyeyiye iyeyiye) 2x